Monday, 14 November 2011

Ghana Is Far Far Better Than Nigeria

Super Sport’s Nigerian editor Emeka Enyadike has written a soul-searching article full in pidgin English admitting that Ghana is better than Nigeria…I mean the Ghanaian football agenda and players are better than their Super Eagles counterpart. He goes on to say, Nigeria MUST learn from Ghana to avoid sidelined from world football affairs.
It is a nice read, it is hilarious and it says the truth….
My people talk say we big pass Ghana, nobody dey drag! We say we get money pass dem, dat wan na true. We even say story story, say na we been dey give dem work, dat wan dey too.
Me sef, na Ghana people follow teach me for skool. One thing wey Ghana people no go gree with us na about who sabi play ball pass and now wey we dey carry last, dem don dey Kampe
.
Dis wan wey Africa cup of Nation don reach so, na siddon look we go dey look yet some people go still dey talk say “ Ghana must go”
Before we win de cup for 1980 wey Shagari come dash de green Eagles moto and house, Ghana been don win am 3 times, but as we dey jollification say we don win,na him dem come win am back wen we go Libya for 1982, dat time sef na Gadhafi pay dere transport After dat time, e come be like say naija come get power pass dem as we come dey win u-17 world cup like pure water.dem too come dey pursue us. Ghana come win Bronze medal for olumpics, we sef vex win Gold de next time.
Naija come even win Africa cup of nations for Tunisia, even first Ghana reach world cup 3 times, 2 times, naija reach second round. All de naija players just brekete for obodo oyibo, for jand, for Paris, for Itali. E be like say Ghana dey carry kpondo that time. Dem come begin plan, dem come begin to organize, and dem come begin to find better player and better Oyinbo coach.
See now, like play like play, Ghana don become Ogbonge team and we dey wonder how e happen? We go dey wonder! We just dey look like Lukman.
Na him we say make we go play dem friendly match for London. Ghana no hold joke oh, nothing friendly about that match, dem knack us 4 kpondo. Na Ghana wey don komot naija for de lats two Africa cup of nations .Dem win us wen dem be landlord for Ghana 2008, come win us again for Angola 2010 wen dem even play with dem small boys. Chei!
Next year wey be for Gabon and Equatorial Guinea, na Ghana wey everybody dey look becos of de way wey dem dey play and dem no dey fear anybody again. Make we no dey talk say “Ghana must go” again oh!
Ghana don come back and dem done balance. Dem dey Kampe! No shaking! Nothing do dem.
See de kain money wey dem dey pay for dere players for Obodo oyibo.Now sef,see those Alhaji dem for Dubai don come pay Assamoah Gyan money yanfu yanfu sake of say make him for come dance for dem.
Naija ! Make we wake up for sleep.Ghana don leave us .everytime we go dey say “Ghana must go.”

No comments:

Post a Comment